Wike Say E No Go Stop To Give Tinubu Enemies High Blood Pressure

Minister of Federal Capital Territory, Nyesom Wike, don vow say he no go stop to give President Bola Tinubu enemies high blood pressure.

Wike yarn say e don clear am say people wey no like Tinubu dey vex anyhow as e dey do better work since e enter office for 2023.

The minister talk this one when dem commission Arterial Road N16 (Shehu Shagari Way) from Ring Road 1 (Nnamdi Azikiwe Way) to Arterial Road N20 (Wole Soyinka Way), plus other roads for Katampe District inside Abuja, wey President Tinubu follow attend on Wednesday.

Wike remember say na one day as e dey watch TV, e come notice say some people dey vex wella because of Tinubu.

E come vow say he go dey commission beta project upon project, make e dey pepper the enemies steady.

Him talk:

“Sometimes, I no know wetin touch me spiritually, I just switch on TV, as I dey watch, I come see say people dey vex. I no know before say dem dey feel pain, but now I don confirm say their body dey hot.”

“From today, na to continue dey give dem high BP. As dem dey vex, we go dey happy. That one don become my new work. I go dey waka up and down, dey laugh, dem go dey shout, dey fight, dey run up and down. Mr President, thank you as you dey support this revolution.”

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *