Skip to content

Elon Musk Tesla Don Add Dogecoin As Payment Method

Elon Musk

Tori don land say Elon Musk, wey be Dogecoin lover and di oga patapata of Tesla, don add Dogecoin as one way wey pipo fit take pay for some Tesla products. Dis one dey inside di FAQs section for Tesla official website. E happun just one month afta wen Elon Musk bin hint say dem go begin accept Dogecoin as official payment for dia cars for future.

Traders hear di tori sharp sharp and di price of DOGE jump pass 20% in just 24 hours. As e be so, DOGE don dey sell for $0.16. Even wit all di gbasgbos wey dey happun for crypto community, Tesla neva still confam weda pipo fit use Dogecoin take buy Tesla cars.

But for now, Elon Musk electric car company, Tesla, don start to dey collect Dogecoin as payment for Tesla Shops. As e dey for Dogecoin support page for Tesla website, customers go need look di Dogecoin symbol wey dey near di “order” page of any product wey dem fit buy wit Dogecoin.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Pidgin Editorial Team

Pidgin Editorial Team

Di Pidgin Editorial team na one group of journalists and writers wey get passion to dey make news available to people for Pidgin English. Dis one na for dose of us wey grow up wit pidgin, we love pidgin well-well and we go love to dey follow wetin dey happen for news using pidgin. We dey here for una.