Skip to content

Iran don warn US and Israel say if dem threaten dia existence, dem go build nuclear weapon o

Iran Supreme Leader

One adviser to Iran Supreme Leader wey dem dey call Kamal Kharrazi don talk say, “We neva decide to build nuclear bomb, but if anybody threaten Iran existence, we no go get choice but to change our military plan.”

E still talk say, “If Israel attack our nuclear facilities, our way of doing tins go change.”

Before, Iran Supreme Leader bin don ban development of nuclear weapons for one fatwa wey e give for early 2000s, say e dey “haram” for Islam.

But for 2021, Iran intelligence minister talk say pressure from Western kontris fit make dem seek nuclear weapons.

Iran dey enrich uranium reach 60 percent purity, but weapons-grade uranium dey around 90 percent. If dem enrich di nuclear material wey dem get now further, e go dey enough for two nuclear weapons according to IAEA.

Kasala burst between Iran and Israel for April afta one attack wey dem suspect say na Israel do for Iran embassy for Syria capital, Damascus. Di attack kill seven members of Iran Revolutionary Guard Corps, including two generals wey dey lead Quds Force for Syria and Lebanon.

Iran come retaliate by launching about 300 missiles and drones against Israel.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Pidgin Editorial Team

Pidgin Editorial Team

Di Pidgin Editorial team na one group of journalists and writers wey get passion to dey make news available to people for Pidgin English. Dis one na for dose of us wey grow up wit pidgin, we love pidgin well-well and we go love to dey follow wetin dey happen for news using pidgin. We dey here for una.