Skip to content

Iran President Raisi Don Die For Helicopter Crash

Ebrahim Raisi

Dem don confam say Iran President Ebrahim Raisi don die inside helicopter wey crash.

De chopper wey also get Hossein Amirabdollahian, foreign minister; Malek Rahmati, govnor of East Azarbaijan province; and Hojjatoleslam Al Hashem, Tabriz Friday prayer leader inside, crash-land for Varzaqan area on Sunday afternoon.

Search and rescue people wey dey find dem for de mountain wey get plenty fog overnight, come see de crash early Monday.

Dem bin elect Raisi, 63, as president for im second try for 2021.

People bin dey see am as person wey fit replace Ayatollah Khamenei, de country supreme leader wey don dey dat position since 1989.

For 2019, Khamenei bin make Raisi oga for judiciary.

Raisi sef na deputy chairman for Assembly of Experts — de 88-member group of religious people wey dey responsible to choose de next supreme leader.

State media talk say Iran govment do emergency meeting afta dem confam say de president and some members of im cabinet don die on Monday.

Vice President Mohammad Mokhber na im lead de emergency meeting.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Pidgin Editorial Team

Pidgin Editorial Team

Di Pidgin Editorial team na one group of journalists and writers wey get passion to dey make news available to people for Pidgin English. Dis one na for dose of us wey grow up wit pidgin, we love pidgin well-well and we go love to dey follow wetin dey happen for news using pidgin. We dey here for una.