Skip to content

Russia Don Put Zelensky For Dia Wanted List

Volodymyr Zelensky

Tori come out on Saturday say di name of Ukraine President, Volodymyr Zelensky, don appear for di ‘wanted’ list of Russia interior ministry. Dis na di online database wey get di names of pipo wey Russia authorities say dem commit crime. Di list talk say dem want Zelensky sake of “one article for criminal code”, but dem no give more details.

Russia officials neva yarn anytin about why dem add Zelensky name for di list.

Ukraine foreign ministry say dis decision show say “Russia state machine and propaganda don taya and dem no know wetin else to do to make pipo look dia side”.

Last year, Zelensky bin tok say e know about “five or six” times wen pipo bin plan to kill am, but dem no succeed.

One day afta Russia send dia troops enta Ukraine, Russia President Vladimir Putin give speech to im kontri pipo say make Ukraine army remove Zelensky from power.

Russia don put plenti foreign politicians and ogbonge pipo dia wanted list wey get like tens of thousands of names.

Di oga of Ukraine Land Forces, Oleksandr Pavliuk, and di former Ukraine president, Petro Poroshenko, dia names still appear for di online database on Saturday.

For February, Moscow bin say dem dey find Estonia Prime Minister, Kaja Kallas, sake of wetin Kremlin call “to spoil history memory” afta Estonia move to destroy monuments wey dem build for Soviet era.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Pidgin Editorial Team

Pidgin Editorial Team

Di Pidgin Editorial team na one group of journalists and writers wey get passion to dey make news available to people for Pidgin English. Dis one na for dose of us wey grow up wit pidgin, we love pidgin well-well and we go love to dey follow wetin dey happen for news using pidgin. We dey here for una.