Site icon PidginNews

Tinubu and Shettima Go Start to Dey Pay for Airport Tollgate

Tinubu and Shettima

Tori don come out say President Bola Tinubu and Vice President Kashim Shettima go begin pay money anytime dem use airport for Naija.

Dis one na because Federal Executive Council (FEC) don gree say dem no go give anybody free pass again to dey use airport without to pay for tollgate.

Na di aviation oga, Festus Keyamo, na im carry dis matter go FEC. Im argue say government dey lose plenty money, like 82% of wetin dem suppose collect from dose e-tags wey dey allow person to pass di tollgates.

Keyamo explain say for di first time, dem bin talk for di memo say na only president and vice president go dey free, but Oga Tinubu come overrule am say make dem add am and im deputy join dose wey must to pay.

For di tori wey Keyamo share after FEC meeting, im dey vex say na dose big ogas (VIPs) wey suppose dey pay, na dem never dey pay at all.

Di minister still yarn say na only poor people dem dey always charge to use di tollgates and say dis kind thing must to stop.

Exit mobile version