Super Eagles striker, Kelechi Iheanacho, don vow say he go prove himself for Sevilla.
Di Nigerian international don return to di Spanish club after him loan for Middlesbrough last season.
Iheanacho yarn Mundo Deportivo say him dey excited and fully ready to show wetin he fit do this time.
“I dey really happy to come back here. Na better place be this. E make sense to go out go feel football for different environment,” Iheanacho talk for di interview.
“Sevilla na big club. I enjoy my time there before. Dem get better team and I go happy to dey play for them again,” he add.



