Liverpool Don Enter Talk to Sign Victor Osimhen

Liverpool still dey find new striker, and report don show say dem don enter talks with Nigerian hitman, Victor Osimhen.

As e be say Darwin Nunez fit comot and even Luis Diaz dey eye exit, new Liverpool coach Arne Slot don dey look for sharp striker. Dem first reason Newcastle striker Alexander Isak, but e be like say di money wey Newcastle dey ask too heavy.

Meanwhile, Victor Osimhen wey dey Napoli reject big money offer from Saudi Arabia just few weeks ago. Na im make Liverpool sharply enter di race to sign di 26-year-old wey talk say he wan play for Premier League next season by fire by force.

Di Nigerian international wey get £63 million release clause for him Napoli contract score 37 goals in 41 games when e dey Galatasaray on loan. But di Turkish side no fit gather di money to buy am permanent this summer.

Saudi club, Al-Hilal bin ready pay di money, but Osimhen no gree. Now rumours don strong say Liverpool wan carry am go Anfield.

According to wetin TBR Football yarn, Liverpool and Manchester United don get better talks with Osimhen people, while Chelsea don comot body after dem sign Liam Delap.

Osimhen don always talk say na England e wan play ball, and e be like say Liverpool now get better chance to grab di former Lille striker.

If dem fit land Osimhen, e go complete better summer signing for Coach Slot, as Bayer Leverkusen baller, Florian Wirtz too dey near to join di Reds.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *